
Man goes mad following his girlfriend’s Valentine demand
He said
“Bella make I warn you. This one na warning. Make I warn you, no dey send me useless demand. I no dey pick money for ground, if you dey pick money for ground that’s your own cup of tea. You open your mouth two days ago talk say you want start valentine business, I tell you say I hear. If that time reach. I dey broke this period. I no get money. I go work towards am, anything wey dey my hand I go give you make you join do your Valentine business.
That one no be productive thing wey you go take get money? That one never finish you dey ask me where I wan carry you go for valentine’s. For February, and we dey January, so na where them go carry you go valentine na him be wetin you dey think for January now. You no dey think how you wan make something productive, na where you wan go na him you dey think. When I tell you say I no get money, I don broke this period.
Respect yourself o. So the entire January na wetin you dey think, where you wan go for valentine’s. Na that kind life you wan dey live. If I continue with you like this you go make me a broke man na, you go make me a beggar. The thing wey go impact your life you no wan do am, na wetin you go post na him dey do you. People carry January dey plan life na valentine you carry full for head…”
