
Man calls Cubana Chief Priest out, Accuse him of using his glory
In his words
I want make una tag Cubana Chiefpriest please. Nigerians abeg abeg I want beg una for one thing. I want make una tag Cubana Chiefpriest please for this comment section. I want beg Cubana Chiefpriest please make you send your aza (account details). I want send your money back, the money dey cause problem for my life. E dey like say they steal person glory. Cubana Chiefpriest please send your aza I want credit you back. I don tire. If I leave this place they go they tell me say me I don’t collect five million I don’t collect ten million I never collect shishi na five hundred thousand.
I want return the five hundred thousand naira back. Na five hundred thousand I still they use they lift now they no show me road. No be say Davido people they go they back they go they pursue me like area boy like the video still they pay me oh. Cubana Chiefpriest please I go sue you, you go see for court abeg send your aza.
I want credit your money back thank you sir. Nigerians abeg I I no play oh, this thing they destroy my life abeg me na I just send you tag Cubana Chiefpriest please say I want return in money back oh thank you sir.
